Anglophone crisis: Who bi de dancing lady weh separatists 'kill' for Cameroon?

 Anglophone crisis: Who bi de dancing lady weh separatists 'kill' for Cameroon?

Dancing lady weh separatists 'kill' for Cameroon?

6 August 2020


Social media di scatter wit reason weh separatist fighters, 'Amba Boys" kill young girl for Bamenda.

One video go viral social media, for inside, one ngondere di dance for corner one guy. Den anoda video show de ngondere weh e lie inside her blood.

Who bi de dancing lady weh separatists kill?

Treasure Keno na e name, and e komot Batibo, Momo Division for Northwest region.

Family friend, John Wirkar tell BBC Pidgin say Treasure drop out from school and e bi don di live some kana life for 'waka' 'akwara'.

Weti really happun?

Some video show say deh first rape, den kill Treasure, drop de die bodi for road for August 3.

Separatists kill de girl for Alabuka di guard de die bodi for see who di kam take'am.

Treasure bi di waka wit 'Amba Boys' before and wen one of dem die deh take e go prison for Bamenda Up station.

Wen e komot, some pipo say goment forces don gada informate from her and e di give spy for dem.

Before deh kill Treasure, separatists fighters don di use, words laik, spy, traitor blackleg for kill pipo as Anglophone crisis weh e start for 2016, enta fighting gear.

'Amba Boys' di claim say na blacklegs di show dia families and oda pipo make army kill for inside de crisis.

So for dem, for bi army officer e girlfriend, sell for dem, or relate wit dem na reason for kill.

Capo Daniel, for ambazonia defence forces, ADF for one audio di justify de killing say e respect Geneva convention weh e say any kontri fit kill spy from anoda kontri.

E also quote Bible how e tok make de stone spy sotei e die.

Plenti pipo run from dis areas for Northwest region for seka say deh go tag dem as blacklegs and target dem for killing.

Right groups don condemn dis violation of human rights, take some man e life because de pesin na blackleg, spy and friends wit 'La Republic du Cameroon'.

Clodtilda Andiensa, Northwest regional coordinator for Southwest/Northwest Women's Task Force, SWNOT for Bamenda don condemn dis killing.

"No fight war ontop woman dia bodi, woman e love life no get for bi decided by parties inside conflict", SWNOT tok.

No bi de first taim, 'separatists di kill pesin weh deh tag spy.

BBC Pidgin make calls for army tok-tok pesin but e no pick de call